Trouble In Paradise As Blackboy’s Wife Exposes Chioma Good Hair And Ashmusy For Sleeping With Her Husband
Popular Nigerian Blogger, Gistlover as openly exposed Chioma good hair and Ashmusy for trying to destroy a home and the man bankrolling them.
The wife of the man had sent Gistlover screenshots of their conversation via admin, so guys kindly read below
‘Meet the Dubai based married yahoo boy bankrolling Chioma good hair, the guy is married and according to my source na this lady dey part of who built the guy, she introduced him to ighalo,oni cubana and the rest because the wife na model so she sabi all those people, after pepper don rest finish naso all these Instagram SpongeBob yansh no let them enjoy their marriage, from one slay queen to another,one would have thought all these girls get level but No, once you can pay their money you are good to go, you marry or not no concern them, before they even met Chioma don begin send nude to the guy the wife saw it but the husband destroyed the phone she kept all those nudes even after Chioma don know say house wife know she no still stop ooo because the boy dey bankroll am, the wife got angry and told her Friends wetin Chioma dey do to her marriage and she and the husband fought silly over this Chioma matter,as it is the matter never settle, that one dey there never settle yet Ashmusy with her rubber yansh too dey the boy dm dey ask if him want sponsor am , papaya for one side go Dubai the guy rent luxurious cars for her she no gree pay finish, all these dirty lifestyle yet they come online to preach what is not,men go sponsor them go trips them go dey shout hardwork dey disturb our sleep on Instagram, DO YOUR HOEING AROUND IN PEACE BUT MAKE UNA NO DEY DECEIVE PEOPLE, BE LIKE I STILL SOME VIDEOS WEY UNA BIG PAPS DO WITH THE GUY STILL DEY, OYA MAKE UNA BEBGIN PACK UNA FAVORITE FOR GROUND ONE BY ONE , EYIN FANS ORAN, EMA KE KU NI, I DEY COME’
See photos below…..
Leave a Reply